But pipol go tell una make una go meet doz wey dey si vishon, so dat dem go give una message and afta dem don tok anyhow, dem go sey, “Make una go meet dead body spirits, so dat dem go help una.”
“ ‘Man or woman wey dey woship dead body spirit, dem must kill dem. Dem must stone dem die and anybody wey do dis tin go sofa di ponishment for en sin.’ ”
One day, as wi dey go di place where dem for dey pray, one slave girl wey get spirit wey dey make am si vishon, kon si us. Di girl oga dey use am make plenty money, anytime e tell pipol wetin go happen.
Saul dress so dat pipol nor go know sey na en den e kon go with two of en men. Wen dem rish where di woman dey for nite, e kon sey, “Abeg, make yu use yor pawa take koll di pesin spirit wey I go tell yu.”