Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 17:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Una go-go meet di Levi priest or di judge wey dey on duty. Dem go hear di kase kon give judgement.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 17:9
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But for Izhar family, dem give Kenanaya and en shidren work outside di temple, as ofisas and judge for Israel.


Wen dem get any matter, di pipol go kom and I go judge and let dem know God kommand, en rules and law.”


But if dem nor katch di tif, den di owner of di house go-go stand make dem judge am, weda naim take en neighbour propaty.


Den di pipol sey, “Make una kom, make wi do sometin about dis Jeremaya! Wi go always get priest wey go dey to tell us wetin wi go do; wise pipol go dey wey go advise us and wi go always get profet wey go prish God word give us. So make wi lie against am kon stop to listin to anytin wey e tok.”


“Wen any kase dey kourt, na di priests go judge am akordin to my law. Dem go make sure sey dem kontinue di festival akordin to my rules and laws and dem must keep di Sabat Day holy.


E sey, “Make yu go ask di priest wetin di law tok about dis tin:


“God wey dey mighty sey, ‘If yu obey my laws kon keep my kommands, na yu go bi oga for my temple and for my kourt and I go add yu join all dis angels wey dey my side naw.’


Den make dem still ask di priests and profets dis kweshon: “Make wi kontinue to mourn and fast for di fift mont just as wi dey do since?”


Na priest work to tish di trut about God. So make pipol go meet and learn wetin I wont from dem, bikos na Oga God send dem.


For all di towns wey di Oga una God dey give una, make una pick doz wey fit judge from each tribe for Israel. Di judge dem must judge di pipol well.


Una must do as dem judge for di place wey God choose. Una must do just as dem tok.


Den di Levi priest go kon front (bikos di Oga una God don choose dem to serve am and to bless una with en name). Na dem go dey judge both good and bad kase for di town.


If two pipol kworel kon go kourt and di judge sey one dey rite and di oda one dey wrong.


Dem go tish Jakob yor law kon tish Israel pipol yor kommand: dem go offa betta incense for Yu kon burn good ofrin for yor altar.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ