Deutronomi 17:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
16 Make di king nor build big house where e go put horse, or make di pipol go back to Egypt go buy horse, bikos God don sey, “Make una nor go back to Egypt.”
For dat time, Adonijah wey Haggit born for David kon dey boast dey sey, “Na mi go bi king!” So e buy plenty horse with pipol wey go dey drive dem and with fifty men wey dey escort am.
So make yu send yor men go Lebanon go kut cedar wood for mi. My men go work with dem and I go pay yor men any prize wey yu tok. Yu know sey my men nor sabi kut trees like yor men.”
Solomon get 4,000 place where e dey keep en shariot and ordinary horse put and e get 12,000 horse. E keep dem for some towns wey e choose and for Jerusalem town too.
Wen Fero free di pipol, God nor take dem pass Filistia pipol land even doh, na dat side near pass, bikos God sey, “Make di pipol nor go shange dia mind wen dem si war kon sey, ‘Wi won go back to Egypt.’ ”
Moses kon tell di pipol, “Make una nor fear! Make una get faith and una go si how God go take save una; bikos dis Egypt sojas wey una dey si today so, una nor go ever si dem again.
But Judah king go against Babilon king. E go hire horse and many sojas from Egypt. Naw, with all dis one, e go fit win di fight against Babilon king? E go fit do wetin e plan? E go fit break di agriment and nobody go ponish am?
Assyria pipol nor go fit save us and awa shariot nor go fit protet us. Wi nor go ever tell juju again sey, ‘Na yu bi awa god!’ Na Yu God dey save doz wey nor get papa and mama again.”
Den God go put una for ship kon send una go back to Egypt, to di place wey E promise sey una nor go ever si again. Den for der, una go sell unasef give una enemies as slaves, but nobody go gri buy una.”
E sey, “E get di way di king go take rule una; e go turn una shidren to sojas; some of dem go bi savant for en shariot and odas go dey run follow di horse.