Di day wen dem start di Bread wey nor get yist feast and wey dem dey sakrifice small sheep, Jesus disciples kon ask am, “Where yu wont make wi prepare for yu to chop Passova food?”
Una Passova sakrifice go bi from di animal wey una get and una must sakrifice am give di Oga una God for di place wey E sey make una woship am; where E choose make dem honor en name.
Make dem nor si yist for anybody house for dis land thru-out di seven days. And wen una sakrifice di Passova lamb for evening for di first day, make una nor let any meat remain till morning.
Una go only sakrifice am for di place wey dem for dey woship God; di place wey di Oga una God choose sey dem go for honor en name. As di sun dey go down, una go sakrifice am der for evening to take celebrate and remember wen una komot from Egypt.