Deutronomi 16:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
18 For all di towns wey di Oga una God dey give una, make una pick doz wey fit judge from each tribe for Israel. Di judge dem must judge di pipol well.
As for yu Ezra, make yu use di wisdom wey yor God give yu, take choose ofisas and judge wey dey obey God and na dem go rule di pipol for West Eufrates. Yu must tish evribody wey nor know di law.
But make yu choose good men from di pipol. Men wey dey fear God; dey tok true; doz wey nor dey play wayo kon make dem rulers ova di pipol. Some fit rule tazons, odas hundred, some fifty, while some go rule ten.
“If two man dey fight and one mistakingly nak woman wey get belle and e kon born di pikin before nine monts, but e nor too wound, dem go ponish am akordin to wetin di woman husband ask for and e go pay anytin wey kourt sey make e pay.
But I tell una, anybody wey vex for en broda, God go judge am too. Anybody wey curse en broda, go face di kansol and anybody wey koll pesin, ‘Mumu’, go-go hell-fire.
Make una nor judge anyhow or judge wetin una nor know. Make di judge dem nor take bribe from pipol, bikos bribe dey blind wise pesin eye kon spoil betta pipol mind.
Anybody wey nor gri obey wetin di judge or di priest wey dey ripresent di Oga una God tok, una must kill dat pesin. Like dis, una go end bad and wiked tins for Israel.