Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 15:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 But make una nor chop blood. Una must pour di blood for groun like wota.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 15:23
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But make una nor chop meat wen en blood still dey inside am.


Naw, make yu tell dem wetin mi God wey get pawa dey tok: ‘Una dey chop meat with dia blood; dey woship juju and dey kill pipol. So wetin make una tink sey na una get di land?


“ ‘If any Israel pesin or strenja wey dey stay for di land chop meat wey still get blood, God go turn against am and e nor go dey among God pipol again.


“ ‘Una must nor chop anytin wey still get blood for inside. Una must nor do majik or serve juju.


E nor matter where Israel pipol dey stay, dem must neva use bird or animal blood take do food.


but instead, make wi rite leta go give dem sey, make dem nor chop food wey dem sakrifice give juju and make dem nor sleep with who dem nor marry, animal wey dem kill and di blood nor tosh groun, make dem nor chop or drink en blood.


But una fit kill una animals kon chop en meat for any town wey una wont. Una fit chop di animal wey God give una as una like. All of una, weda una dey klean or not, fit chop meat, just as una dey chop gazelle and deer.


But una must nor chop blood. Una must pour di blood for groun like wota.


But make una nor chop blood, bikos blood na life and una must nor chop animal blood with di meat.


Instead, make una pour di blood for groun like wota.


So di sojas kon rush with honga, bigin kill both sheep, kattle and melu. Dem kill dem kon chop di animal, di blood and evritin.


So dem kon tell Saul wetin dey happen, “Si, di sojas don sin against God as dem dey chop evritin plus blood sef.” Saul kon sey, “All of una don break di kovenant! So make una roll one big stone kom here.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ