Wi still promise sey wi nor go buy korn or anytin wey strenjas go karry kon sell for us for Sabat Day or for any oda day wey holy. For evry sevent year, wi nor go plant anytin for di land and wi go kounsol all di debt wey pipol dey owe us.
Dis na how una go dey do am. Evribody must kancel di debt wey dia fellow Israel broda dey hold dem. Dem must nor sey make dia neighbour or rilative pay dem back, bikos God time to free pipol, don rish.
Make una dey kareful, if not wiked tins go full una mind, den una nor go give pesin money, bikos di seven years don dey near. If una nor gri give di pesin money and di pesin kon kry give God, dat mean sey una don kommit sin.
Moses kommand dem: “For di last day for evry seven years, for di rite time for di year wey dem dey kansol pipol debt, durin di time wey dem dey do Shelta First,