Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 13:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 But for di profet and doz wey dey si wetin go happen, make una kill dem, bikos dem won make pipol sin against di Oga una God wey take una komot from Egypt where una for bi slave. Una must kill dem, bikos dem dey try to deceive una komot from di way wey God wont make una follow. So like dis, una must skata and distroy evry bad tin or pipol wey dey among una.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 13:5
34 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So di profet wey kom from Judah follow di old profet go en house go chop.


Profet Elijah tell dem, “Make una hold di Baal profets! Make una nor let any one eskape!” So dem hold di profets and Elijah karry dem go Kishon Valley kon kill dem for der.


Di king stand near di pila kon make new kovenant with God sey dem go follow en kommand, laws and rules wey dem rite for di book with all dia heart.


I nor send doz profets, even doh dem dey lie with my name. Dem fit dey sey, ‘War and honga nor go dey for di land.’ But dis na wetin mi wey bi Oga God dey tok about dem: ‘Na war and honga go kill doz profets.’


Bikos e sey make my pipol go against mi, I go kill all en shidren-shidren and e nor go dey alive to si all di good tins wey I go do for my pipol. Mi, wey bi God, don tok.”


My pipol bi like sheep wey waka lost. Who dey guide dem don make dem lost. Dem dey waka anyhow for di mountins; dey from one hill go anoda. Dem don forget dia place where rest dey.


But I kommand dem sey, ‘Make una obey mi and if una obey mi, I go bi una God and una go bi my pipol. Make una live una life as I tell una and evritin go betta for una.’


But if anybody still get di mind to lie sey e dey profesai, na en own papa and mama go tell am sey, ‘Na deat go bi yor own, bikos yu dey lie with God name.’ Den if e still profesai, en papa and mama go shuk am die with swod.


But “Elymas” wey bi magician, (bikos na wetin en name mean bi dat) kon dey oppoz dem, so dat di Roman offisa nor go bilive wetin dem dey prish.


Na God go judge doz wey dey outside, bikos en word sey, “Doz wey dey do wiked tins among una, make una drive dem komot from di church.”


Una must stone dem die, bikos dem try to make una turn from di Oga una God wey diliver una from Egypt, di place where una for bi slave.


den make una make sure sey una kill all doz wey dey di town; plus all di animals wey dem get.


Una must kill dem! Make una bi di first to attack dem and evry oda pesin go join una.


den make una take di man or woman wey kommit dis sin go outside di town gate kon stone am die.


Di pipol wey tok about di tins wey di pesin do, na dem go first stone di pesin, before oda pipol go join dem. Like dis, una go stop wiked and evil tins among una.


But any profet wey tok wetin I nor send am or tok about any oda god, go die.


den di deat wey e won make e broda die, na en go die-am. Like dis, una go remove all dis bad pipol among una.


den dem go take di woman go en papa door-mot. For der, di men for di town go stone am die. E don kommit bad sin for Israel, bikos e dey sleep with difren men wen e dey en papa house. Like dis, una go remove evil from among una.


una must bring di two of dem kom di town gate kon stone dem die. Una go stone di girl die, bikos e nor kry wen di man dey sleep with am and una go kill di man, bikos e sleep with di woman wey en broda suppose marry; like dis, una go remove evil from among una.


If una katch pesin wey kidnap anoda Israel pesin kon dey trit am like slave or sell am, di pesin wey kidnap anoda pesin, must die. Like dis, una go remove bad-bad tins from among una.


Even wen wi dey mourn, wi nor chop any one; wen wi nor dey klean at-all, wi nor tosh am and wi neva offa any of am to dead body. Wi don obey di Oga awa God and wi don do evritin wey Yu kommand us.


Wen una look di sky kon si di sun, moon and stars and as evritin bi for heaven, make una nor let anytin move una to woship or serve dem, bikos di Oga una God don give dem to di pipol for di eart.


Una must fear di Oga una God kon serve am. Una must use only en name take swear.


bikos dem go take una shidren from mi kon let dem go woship anoda god. Den God go vex for una well-well kon kwik distroy una.


But una must dey loyal to di Oga una God, as una don dey loyal till today.


So dem seize di beast and di fake profets wey dey help am do mirakles to deceive pipol wey kollect di beast mark and woship en image. Den dem trow dem two inside di fire wey sulfur dey and di fire burn dem alive.


Make una release doz wiked men, di trobol-makers from Gibeah, so dat wi go kill dem take klean Israel land from dis bad tin wey una do.” But Benjamin pipol nor gri.


If una fear God kon serve and obey am and una nor go against wetin E tok and if una and di king wey dey rule una follow di Oga una God, den evritin go dey well with una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ