Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 13:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Doz profets wey dey si wetin go happen, make una nor listin to dem, bikos di Oga una God go dey test una, to know weda una love am with all una mind and heart.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 13:3
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So di profet wey kom from Judah follow di old profet go en house go chop.


Pipol wey dey follow en rules kon find am with all dia heart, make una si as dia blessing many rish.


My God, Yu don test and make us klean like silva.


Una kry to mi for help wen una dey trobol and I save una; I ansa with strong tonda kon test una faith wen wota nor dey to drink for Meribah.


Moses tell di pipol, “Make una nor fear, God just kom test una, so dat una go fear and always dey obey en kommand.”


Den make una remember God kommand and evritin wey di profets sey go happen. True-true, all di pipol wey dey si vishon, dey tok all dis tins, bikos dia mind dey dark.


Lie-lie messiahs and profets go kom do big-big mirakles take deceive pipol. If e possibol sef, dem go deceive pipol wey God choose.


Dis Jew pipol get betta mind pass di ones wey dey for Tesalonika, bikos dem open mind take bilive di message and dem dey read God word evriday to shek weda all di tins wey dem hear, na true.


Bikos if una nor kworel, wi nor go know di good ones among una.


Nor bi sey I dey kommand una, but I won si weda una love na really won like di oda church pipol own.


So make wi nor bi like shidren wey breeze dey karry up-and-down; shidren wey dey follow yeye tins wey human being dey tish and na dis tins dem dey take deceive pipol.


So una must love di Oga una God with all una heart, all una soul and all una pawa.


feed una for di wildaness with manna (food wey una grand-grand papa nor ever know), so dat E go honbol and test una, den make una betta pipol.


Make una remember how di Oga una God guide una pass di wildaness for dis forty years, so dat E go fit honbol and test una to si if una go fit keep en kommand or not.


So God go make dem deceive dis pipol well-well and dem go bilive dia lie-lie.


Na from us dis pipol from komot, but dem nor really dey God family before, bikos if to sey dem dey, dem for stay with us. But dem live us, so dat evribody go know sey dem nor bi awa own.


My friends, make una nor bilive evribody wey sey na God Spirit dey tok thru am. Una must test am to know weda na God Spirit e really get. Bikos many fake profets dey for dis world.


My shidren, una kom from God and una don get viktory ova doz pipol, bikos di pesin wey dey inside una, big pass di pesin wey dey di world.


E deceive di pipol for dis eart with di mirakles wey e dey do for di beast front and e tell di pipol sey, make dem make one image for di beast (wey wound before, but still dey alive).


I go use am take test dem weda dem go follow mi, just as dia grand-grand papa do.”


So naw, make my oga di king listin to wetin en savant won tok. If na God make yu hate mi; if I offa ofrin to am, E go shange en mind, but if na human being make yu hate mi like dis, God curse go fall for dia head! Bikos dem don porshu mi komot from God land wen dem sey, ‘Make yu go. Go serve anoda god!’


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ