I go really bless yu kon make yor shidren-shidren plenty well-well and nobody go fit kount dem, just as nobody fit kount stars for sky or di san-san wey dey near river. Yor shidren-shidren go take all di tins wey bilong to dia enemies.
Make una make sure sey una obey all di kommand wey I dey give una, so dat evritin go dey well with una and una shidren-shidren, bikos una do wetin dey good and betta for una Oga God eye.
Anytin wey God sey E go judge, una must nor take am at-all. Den God nor go vex again, but E go sorry for una kon make una plenty as E promise una grand-grand papa.
Any propaty wey God nor like, make una nor take am enter una house, bikos if una do so, God go distroy una just as E do to doz pipol. Make una make sure sey una nor do dat kind tin, bikos God go distroy dem.