If di place wey God choose sey una go woship am too far for una, una fit kill any of una animal wey E don give una, just as I kommand una; kon chop dem for una town as una like.
Instead, make una use am take kook for una family for house. Anybody, weda e dey klean or e nor klean, fit chop from am, just as anybody fit chop deer or gazelle.