Deutronomi 12:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
14 Una go only sakrifice am for di place wey God go choose from among una tribe. Na der una go for offa una burnt ofrin and do evritin wey I kommand una.
May bi yu go tell mi sey, “Wi dey trust di Oga awa God.” But na Hezekaya skata en high place, distroy en altars kon tell Judah and Jerusalem pipol sey, “Una must dey woship for only dis altar for Jerusalem.”
So, bikos of Christ, God dey turn di world from en enemy, to en friend. E nor dey kount pipol sins against dem and E don give us di message wey go make pipol bi en friend.
una must bring evritin wey I kommand una: una burnt ofrin; sakrifice ofrin; tithe and vow ofrin kom di place wey God choose as where dem go for woship and honor en name.
But una fit kill una animals kon chop en meat for any town wey una wont. Una fit chop di animal wey God give una as una like. All of una, weda una dey klean or not, fit chop meat, just as una dey chop gazelle and deer.
Una must chop dis tins for di Oga una God present and e go bi for di place wey E choose. Make una chop for der with una shidren and Levi wey dey stay with una and for evritin wey una dey do, make una dey celebrate for di Oga una God present.
Una go bring am kom di Oga una God present, so dat en go chop from una plant, new wine, olive oil and evry first-born for una animal. Una go bring am kom meet am for di place wey E choose sey una go for honor en name, so dat una go learn to always woship di Oga una God.
Una Passova sakrifice go bi from di animal wey una get and una must sakrifice am give di Oga una God for di place wey E sey make una woship am; where E choose make dem honor en name.
If matter too strong for una to judge; matter like to kill pesin or matter wey koncern propaty or wahala for village, make una karry doz kind matter go di place wey di Oga una God don choose.
“Wi nor go ever disobey God and wi nor go fit turn back from God kon build altar wey wi go dey burn ofrin or do sakrifice put, apart from di altar wey dey awa Oga God Temple!”
and from dat day go, e kon make dem dey kut wood and karry wota for di kommunity and for God altar. Till today, dem still dey do dis work for where God choose sey, make dem dey woship am.