Small shidren nor go die again and evribody go get long life. Even wen pesin don rish hundred years, dem go sey e still dey yong. If dem die before dat time, e go bi sign sey, I ponish dem.
If una obey di kommand, una go get long life for di land wey God promise sey, E go give una grand-grand papa and una wey bi dia shidren; land wey milk and honey full!
If una obey all di laws and kommand wey I dey give una today, e go betta for una and una shidren. I dey give una dis kommand, so dat una go get long life for di land wey di Oga una God dey give una forever.
Make una honor una papa and mama, just as di Oga una God don kommand una, so dat una go get long life and e go dey well with una for di land wey E won give una.
Una go make sure sey una respet Oga God and obey all en statutes and kommandments wey I dey give una – una, una shidren and grand-shidren – go obey am with all una life so dat una go get long life.
God don bless di holy pipol wey join for di first resureshon! And dis pipol nor go die again, but dem go bi God and Christ priests and dem go rule with am for 1,000 years.