“So tell Israel pipol sey, ‘Na mi bi Oga God and I go remove di load wey Egypt pipol put for dia head and dem nor go bi slave again. Na my pawa I go take save una and I go ponish Egypt pipol.
But dem wound am bikos of awa sin; dem beat am bikos of di bad tins wey wi do. Na di ponishment wey e sofa give us peace and en wounds don make us well.
But God don dey help mi till today, so I stand dey tell evribody, weda dem bi small pikin or big pesin. So, wetin di profets and Moses tok sey go happen, naim I dey tell una so,
Or God don ever try to diliver one kountry from anoda kountry with judgement, signs, wonders, war, strent, pawa or any oda tin wey dey make pesin fear like di ones wey God do for Egypt for una own eyes?
Dem kon sey, “Di Oga awa God don show us as en glory big rish and wi don hear am tok from inside di fire. Naw wi don know sey God fit tok to human being and dem go still dey alive.
di betta judgement wey una si, di signs and wonders wey God do; en strent and pawa wey E use take-take us komot der and na so di Oga una God go do to all dis pipol wey una dey fear.
I pray to am, “My Oga God, make Yu nor distroy yor pipol wey bi yor betta propaty; pipol wey Yu save with yor own pawa kon take dem komot from Egypt with yor strent.
Thru-out di time wey Joshua dey alive with doz leaders wey dey with am (before all of dem die), Israel pipol woship God. Dis leaders don si evritin wey God do for Israel pipol.