For der, una must celebrate for di Oga una God present, with all una shidren, savants and Levi shidren wey dey stay una town, (bikos dem nor get land or propaty among una).
Make una gi-am to Levi pipol, bikos dem nor get land or propaty among una. Make una still give to di strenjas wey dey stay with una; shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die, so dat dem go chop beleful. Den di Oga una God go bless una for evritin wey una dey do.