No kountry for dis world bi like Israel wey Yu komot from slave kon make dem yor pipol. Di big tins wey Yu do for dem, make pipol know yor name for di whole world. Yu save yor pipol from Egypt, plus di juju and gods wey dey der.
God sey, “Si, I go make kovenant with Israel pipol. For dia present, I go do many wonders wey neva happen for anywhere for dis world or any kountry. And all di pipol wey dey with yu go si God work, bikos na wetin dey fear pesin, I dey do with una.
Di sun nor go bi una lite for day time again or di moon for nite, bikos na mi, wey bi God, go bi una lite forever and my glory lite go always dey shine on una.