Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 10:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Una must fear di Oga una God kon woship and love am. Wen una swear, e go must bi with en name.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 10:20
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E dey loyal to God and e always dey follow en kommand. E obey all di kommandment wey God give Moses.


But di king go happy bikos of God love. Evribody wey trust God go dey boast, bikos pipol wey dey lie, go shut up forever.


Make una nor use di Oga una God name take make yeye, bikos I go ponish anybody wey do like dat.


So, since yu don hear evritin, dis na my last advise: “Make yu fear God and obey all en kommands, bikos na wetin man suppose do, bi dat.”


Wetin I promise una, na true and nobody go fit shange am. Evribody go kom knee down for my front den promise sey dem go respet and obey mi.


den, na only my name una go take swear sey, ‘As long as God dey alive, wi go do wetin wi promise’, den all di nashons go praiz mi and I go bless dem bikos of una.”


Jesus ansa, “Komot here, devil! Bikos God word sey, ‘Na only God wi suppose to serve and woship.’ ”


Jesus ansa, “God word sey, ‘Na only God yu must woship and serve.’ ”


Wen e rish der kon si how God don bless di pipol, e happy well-well kon enkourage dem sey make dem kontinue to woship God with all dia heart.


Make wi love each oda well-well. Make una hate anytin wey dey bad, but una must love anytin wey get trut.


Make una dey kareful as una dey obey all di kommand wey I dey give una today. Make una show love to di Oga una God kon bilive and do as E sey make una do.


Una must follow di Oga una God kon woship only en and una must follow en kommandment, obey, serve and always dey loyal to am.


Den una go love di Oga wey bi una God kon dey obey en vois and hold am strong, bikos God go give una long life for di land wey E promise to give una grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob.”


But all of una wey dey faithful to God still dey alive till today.


Make una nor use di Oga una God name take make yeye, bikos God nor go sorry for anybody wey use en name anyhow.


If to sey dem go just gri fear mi and obey all my kommand, e for dey well with dem and dia shidren-shidren forever.


Una must fear di Oga una God kon serve am. Una must use only en name take swear.


or kon make friend with di remainin nashons. Una must nor use dia god name take make mout or tok about am! Una must nor woship or bow to dem!


But una must dey loyal to di Oga una God, as una don dey loyal till today.


Samuel kon tell Israel pipol, “If una don really turn from sin kom meet God with all una heart, make una remove all di small-small Ashtoret gods wey una get. Make una give una heart to God kon serve only en. Den E go save una from Filistia pipol pawa.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ