Di strenjas wey dey among una and di ones wey born dia shidren for here, go still kollect dia own share wen una dey divide di land. Una go trit dem as una dey trit Israel pipol and dem go trow dice for each land wey go bi any tribe for Israel own.
But make una love una enemies kon do good and make una nor espect anytin back wen una borrow anybody sometin. Na dis go make God pay una back and una go bi en shidren, bikos God ensef dey do good for wiked pipol and doz wey nor dey sey tank yu.