Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 10:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Doz wey nor get papa and mama and doz wey nor get husband again, E dey make sure sey E fight for dem. E dey show love to strenjas wey dey stay with una kon give dem food and klot to wear.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 10:18
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make una respet God as una dey take decision, bikos di Oga wey bi awa God nor dey like wayo, bribe or anyhow tins.”


Yu go judge well for shidren wey nor get papa and mama and doz wey dem dey opress, so dat wiked pipol nor go ever treaten dem again.


God dey do wetin dey good and dey judge well for doz wey dem dey opress.


God dey good to evribody. E dey sorry for evritin wey E kreate.


God dey guide di strenjas among us. E dey kare for pipol wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die, but E dey ponish wiked pipol with dia wiked plans.


Na en bi papa to di pipol wey nor get papa and na en bi husband to wimen wey dia husband don die. God dey rule from en holy place.


God dey find place put pipol wey don run komot from dia house bikos of war, E dey free prisonas kon make dem prosper. But pipol wey dey sin, dey stay for desert forever.


“Anybody wey sakrifice give anoda god wey nor bi di Oga awa God, dem must distroy am.


“Make una nor sofa or opress strenja, bikos una bi strenja before for Egypt.


“Make una nor sofa wimen wey dia husband don die or shidren wey nor get papa and mama.


If una sofa dem and dem kry kom meet mi, I go listin to dem.


Make una learn to do good; make una make sure sey una dey judge well; make una help doz wey dem dey opress. Pipol wey nor get papa and mama, make una give dem wetin dem wont and make una help wimen wey dia husband don die.”


Shidren wey nor get papa and mama, make yu leave dem for mi and I go kare for dem. Wimen wey nor get husband, make dem make dem kom meet mi and I go help dem.”


Assyria pipol nor go fit save us and awa shariot nor go fit protet us. Wi nor go ever tell juju again sey, ‘Na yu bi awa god!’ Na Yu God dey save doz wey nor get papa and mama again.”


“ ‘If una fellow Israel pesin dey poor and e nor fit support ensef, una must gi-am evritin as una dey give di pipol wey una hire, so dat dem go kontinue to stay with una.


If yu follow us, wi go share all di blessings wey God go give us, with yu.”


so dat una go bi like una Papa for heaven wey dey allow sun to shine and rain to fall on-top bad and good pipol.


but E nor stop to do good for una, E dey give una rain from heaven and food from groun, so dat una go chop and belle go sweet una.”


Strenjas, pesin wey nor get papa and mama or wimen wey dia husband don die, if anybody nor judge dia kase well, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ