“Wen dat time rish, God go blow wiso as sign for Egypt pipol and dem go kom like fly from evriwhere for Nile. Assyria pipol go kom from dia land like bees kon attack una too.
God go still allow una enemies beat una; una go attack dem from one side, but una go run komot seven side, den all pipol for di eart go dey fear bikos of wetin hapun to una.
Ai men kill about thirty-six from dem kon porshu di rest of dem from di town gate go rish di low aria. Di pipol pawa fail dem like ice-blok wey dey melt.