Only one of una enemies soja go kill 1,000 of una, den wons una si five of una enemies sojas, all of una go run until una nor many again kon small like poles wey dey on-top mountin or sign flag wey dey on-top hill.”
I go turn against una kon make una enemies win and di pipol wey hate una, go rule una. Fear go katch una sotey una go dey run wen nobody dey porshu una.
So Filistia pipol kon fight and kill Israel pipol well-well till di remainin ones, run go house. Di pipol wey dem kill many well-well; 3,000 sojas wey dey waka for groun die for di war;