God take am go outside kon sey, “Look di sky and yu go si di stars, den try if yu fit kount dem!” Den God sey, “Na as di stars bi for up, na so yor shidren go plenty rish.”
I go really bless yu kon make yor shidren-shidren plenty well-well and nobody go fit kount dem, just as nobody fit kount stars for sky or di san-san wey dey near river. Yor shidren-shidren go take all di tins wey bilong to dia enemies.
Yor shidren-shidren go plenty like san-san for groun and dem go skata go west, east, nort and sout. I go bless all di family for di world with yu and shidren-shidren name.
Wen David sey make dem kount di pipol, e sey make dem nor kount pipol wey neva pass twenty years, bikos God promise sey E go make Israel pipol plenty like di stars wey dey di sky.
Just as star many for sky, na so di shidren wey Yu give dem many and Yu let dem win and stay for di land wey Yu promise dia grand-grand papa sey Yu go give dem.
Make Yu remember Abraham, Isaak and Israel yor savants wey Yu promise sey, ‘I go make una shidren-shidren plenty like di stars for sky and all dis land wey I don tok about, I go give dem to una shidren-shidren and dem go stay der forever.’ ”
Make una tink of Abraham, una grand-grand papa and Sarah wey born una. Wen I koll Abraham, e nor get pikin, but I bless and gi-am shidren kon make en shidren-shidren, plenty.
So I make yu grow like betta seed wey dem plant. Yu strong as yu dey grow and yu tall like fine woman. Yor breast dey okay and yor hair fine well-well, but yu dey naked.
Den una go sey, “Awa papa Jakob waka from Aramean go stay for Egypt as strenja. En family for dat time, nor many, but wen dem dey komot Egypt, dem kon plenty and dem bi strong pipol naw.