5 As I still dey tink, one man goat kon dey kom from west side. E dey run fast-fast like sey en leg nor dey tosh groun. E get one horn between en two eyes.
But afta yu, anoda kingdom go kom, dem nor go get pawa rish yor own and afta dat one, di third kingdom wey bi bronze, wey go rule di whole eart, go kom.
“Afta all dis tins, as I dey look, anoda beast wey bi like leopard kon kom out with four feada for en back, di feada bi like bird own. Dis beast get four head and dem kom gi-am pawa to rule.
Di goat kon dey strong more-more, but leta, en horns kon break. Den four horns kon grow kom out from where di two horns for break and each of di horns face difren direcshon.