Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Daniel 8:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 So I faint and I kon dey sick for some days. Den afta, I get up kon go do di work wey di king sey make I do. But di vishon still dey sopraiz mi, bikos I nor fit undastand wetin e mean.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Daniel 8:27
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den di angel wey bi like human being, appear kon tosh my lip. I open my mout kon start to tok. I tell am, “Oga God! Dis vishon don make mi weak and na-im make mi dey shake anyhow.


Na only mi dey der wen I si dis great vishon. I nor get strent again and my face kon shange well-well and anybody wey si mi nor go know sey na mi.


Den Daniel (wey en name na Belteshazzar) kon dey worry sotey e nor fit tok anytin. Di king kon tell am, “Belteshazzar, make yu nor let dis dream and en meaning worry yor mind.” Daniel ansa, “My king, e for betta sey dis dream na for yor enemy and wetin e mean, na for di pipol wey dey trobol yu!


I don hear about yu; how di holy gods spirit dey inside yu and yor knowledge, wisdom and undastandin.


“Na like dis di matter take end. But for mi, Daniel, my mind kon dey disturb mi well-well and I kon kover my face bikos I dey fear. But I still keep evritin to mysef.”


Gabriel stand near mi, so bikos I dey fear, I kon fall face groun. Naim e sey, “Man pikin, make yu undastand wetin e mean. Di vishon dey show yu how di world go take end.”


For dis vishon, I si mysef for Shushan wey dey Elam aria. As I stand near Ulai river,


I dey look as e vex kon attack di ram, den e break di ram two horns and di ram nor get pawa to fight am back. Di goat trow di ram for groun kon dey mash am and nobody fit save am.


I fear well-well wen I hear all dis tins and my lips kon dey shake. Fear and kold katch mi at wons. I go really wait for di time wen God go ponish doz wey dey attack us.


So Samuel sleep until day break. Den e open di door for God house. But Samuel dey fear to tell Eli di vishon.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ