For di third year wen King Cyrus for Persia dey rule, God kon give Daniel (wey dem dey koll Belteshazzar) one message. Dis message na true, but e hard to undastand. Daniel undastand di message thru di vishon wey e si.
And na di trut I won tell yu naw.” Di angel still sey, “Three more king go kom from Persia. Den di fourt king go get money well-well pass all di kings wey don dey before am. Wen e don get pawa well-well, bikos of en money, e go karry evribody go fight Greece.
“But Daniel, make yu klose and keep di book for sekret until dis world don end. Many pipol go waste dia strent dey waka up-and-down, bikos dem nor fit undastand wetin dey happen.”
I dey ready to rite wen di seven tundas dey tok, but I hear one vois from heaven dey sey, “Anytin wey di seven tundas tok, make yu keep am as sekret and nor rite dem at-all.”