Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Daniel 8:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 E go dey strong, but nor bi by en own pawa. E go kause strong wahala kon prosper for evritin wey e dey do. E go distroy doz wey get pawa and pipol wey dey serve God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Daniel 8:24
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Pipol wey wiked and nor dey sorry for odas, I don si as dem dey prosper like tree for betta groun,


E go deceive many oda nashons, bikos e sey e dey make peace and e go dey strong evriday, even doh en nashon nor big.


Den I hear di man wey wear linen wey dey on-top di river as e raiz en two hand face sky kon swear with God name sey: “Na only three and half years remain; by di time wen God don save en holy pipol from who dey sofa dem, all dis tins go don happen.”


E go tok against God kon opress anybody wey dey serve God. E go try to shange laws, festivals and di pipol wey dey serve God, go dey under am for three and half years.


E strong rish to attack God sojas for heaven; e even remove and trow some stars for groun kon stand on-top dem.


E still dey praiz ensef pass di sojas for heaven. E stop di sakrifice wey dem dey offa give God evriday kon skata where dem for dey woship God.


Instead of di normal sakrifice wey di pipol dey offa, dem kon start to sin, so dem forget God ways. Di horn dey enjoy evritin wey e dey do.


Wen dia kingdom don dey won end and dia sin don plenty well-well, anoda wiked king wey sturbon and dey lie well-well, go kom ponish dem.


Bikos dis pipol kill yor pipol and profets, so yu don give dem blood make dem drink, bikos na wetin good for dem bi dat!”


Bikos God don put am for dia mind sey dem go do wetin E wont and dem go use one mind take give dia pawas to di beast, until God word go komplete.


God pipol wey dem kill and doz wey prish about Christ, I si di woman wen e dey drink dia blood and di blood dey shark am like wine. I sopraiz well-well wen I si di woman.


bikos en judgement dey true and korrect. E don ponish dat ashawo wey spoil di world with en sins, as e dey sleep with who e nor marry and God don revensh am for Christ savants wey e kill!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ