17 Gabriel stand near mi, so bikos I dey fear, I kon fall face groun. Naim e sey, “Man pikin, make yu undastand wetin e mean. Di vishon dey show yu how di world go take end.”
Di lite wey dey shine round am bi like rainbow afta rain don fall. Dis na di lite wey dey show how God glory bi. Wen I si am, I fall face groun and I kon hear somebody dey tok.
Den di man take mi pass di gate for nort go di temple front. As I still dey look, I kon si God glory dey shine for di temple. At wons, I fall face groun
Di angel kom tell mi, “Daniel! God love yu. Stand up make yu listin well-well to wetin I won tok naw, bikos na God send mi kom meet yu.” Wen e don tok finish, I kon stand up, even doh I still dey shake.
Den di angel wey bi like human being, appear kon tosh my lip. I open my mout kon start to tok. I tell am, “Oga God! Dis vishon don make mi weak and na-im make mi dey shake anyhow.
Di two kings go sidan chop for di same tabol, even doh dem get bad belle for each oda; dem go dey deceive each oda. Dem nor go get wetin dem won get, bikos di time neva rish.
“Wen di end don rish, Egypt king go attack am. Siria king go fight am with all en pawa; with shariot and many ship. E go attack and distroy many kountries like river wey flow enter land.
“But Daniel, make yu klose and keep di book for sekret until dis world don end. Many pipol go waste dia strent dey waka up-and-down, bikos dem nor fit undastand wetin dey happen.”
So I faint and I kon dey sick for some days. Den afta, I get up kon go do di work wey di king sey make I do. But di vishon still dey sopraiz mi, bikos I nor fit undastand wetin e mean.
God don ansa yor prayer since di very first day wen yu start to pray and beg am and na di love wey E get for yu, make mi kom so. Naw, make yu listin well-well as I dey tok kon undastand di vishon:
“ ‘Dat ruler go enter agriment with many pipol for one week, den for di middle of dat week, e go stop all di sakrifice and ofrin. Den e go start one bad tin wey go kause wahala and tins go bi like dat, until di time wey God sey E won distroy di wayo pesin wey kause di wahala.’ ”
Make yu rite am even doh e neva rish time for di vishon to happen. But di time go soon rish and wetin I show yu, go happen. E fit bi like sey e nor go happen, but make yu wait; e go must happen and e nor go tey again.