Den I hear di man wey wear linen wey dey on-top di river as e raiz en two hand face sky kon swear with God name sey: “Na only three and half years remain; by di time wen God don save en holy pipol from who dey sofa dem, all dis tins go don happen.”
E go tok against God kon opress anybody wey dey serve God. E go try to shange laws, festivals and di pipol wey dey serve God, go dey under am for three and half years.
Dem rite for God word before sey, “E go asept Gentile pipol, wen dem get faith” and na dis make am tell Abraham before di time rish sey, “E go bless evribody, bikos of am.”
Di sevent angel blow en trumpet and one loud vois kon shaut from heaven: “All di kingdom for di world don bi God and Christ own. E go rule forever and ever.”
But dem give di woman two feada like eagle own, so dat e go fly go di place where dem prepare for am for wildaness. For der, dem go kare for am kon protet am from di dragon for three and half years.