so I tell di king, “My king, make yu live forever! Wetin nor go make my face look like who dey sick wen e bi sey dem skata and burn di gates for di town where dem beri my grand-grand papa put.”
Di wise men kon tell di king for Aramaik language sey: “Awa king, make yu live forever! Make yu tell yor savants di kind dream wey yu dream and wi go tell yu wetin e mean.”
Nebukadnezzar waka near di fire door kon koll dem, “Shadrak, Meshak and Abednego; God Almighty savants, make una kom out!” Den Shadrak, Meshak and Abednego kon waka komot from di hot fire.