Den Mefiboshet wey bi Saul grand-pikin, kom meet di king. E neva wosh en leg; kut en hair or wosh en klot since di time wey di king komot from Jerusalem till naw wey e dey kom back with viktory.
Silva, golds and oda good tins wey I karry from oda kings and nashons, I still save dem for mysef. I hire good singas, both men and wimen and I get many fine-fine girl-friends. Yes! I get evritin wey suppose make man happy!
So, di pipol wey dey play harp, sing music, blow flute and trumpet, dem nor go ever hear dia sound from yu again. Doz wey get handwork and business pipol, dem nor go ever si dem inside yu again. Pipol wey dey grind tins, dem nor go ever hear dia nois inside yu again.