31 Darius wey bi Media pipol king kon take-ova di kingdom and dat time, e bi sixty-two years.
I go make evritin wey I tok happen for dat land; evritin wey dem rite for dis book wey Jeremaya profesai against dis nashon, must happen.
I set trap for Babilon and e katch dem, before dem know. Una fight against mi and na dis make dem katch and distroy una.
Den for di first year wen Darius bi king for Mede, I kom help and defend am.)
Farsin (division) mean sey: ‘Dem go divide yor kingdom give Mede and Persia pipol.’ ”
Darius choose one hundred and twenty govnors wey go kare for di whole kingdom.
For di first year wen Zazes pikin, Darius wey bi Media king, dey rule Babilon.