Di pipol wey kom back from Babilon asept di plan, so Priest Ezra kon choose some men from among di leaders den rite dia names down. So dem sidan togeda for di first day for di tent mont kon tok about di matter
God allow King Nebukadnezzar katch King Jehoiakim and e karry some of di tins wey dey God temple too. E karry Judah pipol as prisonas go Babilon and di tins wey e karry from Jerusalem, e put dem for en own juju temple.
E get one man for dis yor kingdom wey get di holy gods spirit inside am. Di time wey yor papa, Nebukadnezzar bi king, naim dey kommand all di wise men for Babilon.
As dem dey drink, King Belshazzar orda sey make dem bring all di gold, silva and bowl wey en papa Nebukadnezzar karry kom from God temple for Jerusalem. Di king sey make dem bring dem kom, so dat en, en ofisas, en wife and girl-friends go use dem drink wine.
So dem tell di king, “Daniel, wey bi one of di pipol wey dem bring kom from Judah, nor gri respet di king orda at-all. Na three times a day, e dey pray give anoda God.”
So I faint and I kon dey sick for some days. Den afta, I get up kon go do di work wey di king sey make I do. But di vishon still dey sopraiz mi, bikos I nor fit undastand wetin e mean.