Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Daniel 4:35 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

35 Yu nor fit kompare God with anybody for dis world. E dey do wetin E like with di angels for heaven and pipol for dis world. Nobody fit shalenge or ask am, “Wetin Yu tink sey Yu dey do?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Daniel 4:35
41 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E neva shange and nobody fit oppoz or stop am from wetin E won do.


If God sey E nor go do anytin, nobody go fit ask am kweshon. If E hide en face, wi nor go get help at-all weda na one pesin or di hold kountry.


“Yu dey argue with God Almighty; yu don taya to tok or yu still get word to tell mi?”


“I know sey na Yu get pawa pass! Yu fit do anytin wey Yu won do and nobody fit stop!


God too get sense and en pawa dey mighty; nobody fit stand against am.


Awa God dey for heaven and E dey do wetin E like.


E dey do anytin wey E like for heaven and eart, both for under di sea and ocean too.


Evritin wey dey alive for dis eart, God dey look dem from en throne.


Si! Yu don make my life short well-well and my whole life bi like one sekond to Yu. True-true, evribody life just bi like breeze wey dey blow pass.”


Evribody, make una listin to wetin I won tok! Evribody for di world, make una put una ear for groun!


Yor wisdom, brain and undastandin nor mean anytin if God dey against yu.


Anytin wey e kommand, pawa dey follow am and nobody go fit go against or kweshon en authority.


Den Judah pipol go sofa Egypt pipol and anybody wey go hear Judah pipol story, go dey fear, bikos of wetin God wey dey lead heaven sojas won do dem.


I look for Yu for nite, my spirit dey find Yu for morning, bikos wen Yu start to judge di world, den pipol for dis world go know and learn how to bihave well.


Even before I kreate di day, I bi who I bi and nobody fit eskape from my pawa. Na who fit shange or skata wetin I don do?”


E dey perform mirakle and wonders for heaven and for dis eart, E dey diliver and save pipol well-well. E don save Daniel from lions mout.”


So dem kry to God sey, “God wey get pawa, wi beg, make Yu know let us die, bikos of dis man! Make Yu know ponish us sey wi kill dis innocent man, bikos Yu wey bi Oga God, must do wetin Yu wont.”


So my pipol, if God fit give doz Gentile pipol di same gift wey E give us afta wi bilive Jesus Christ, who I bi to stop God?”


and dem dey do wetin yu don already plan sey go happen.


but if na from God, una nor go fit stop dem, escept una won fight God.”


So e ansa, “Oga God, na who dey tok so?” Di vois ansa am, “I bi Jesus Christ wey yu dey ponish!


Abi wi dey try to make Christ vex? Wi strong pass God?


bikos God word sey, “Who fit know wetin God dey tink so dat e go advise am?” But wi wey get di Spirit, undastand wetin Christ dey tish.


All tins dey happen as God wont am and thru Christ, E choose us to bi en own pipol, bikos na so E plan am from di time wen E kreate di world,


Jeriko king hear sey some pipol from Israel don kom spy di town,


So Samuel tell Eli evritin. E nor hide anytin from am. Eli kon sey, “Make God do wetin E like.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ