“Yu don si how King Ahab honbol ensef for mi since wen yu tell am wetin I tok? I nor go bring wahala kon gi-am wen e still dey life, but na en pikin go take head karry am.”
Assyria king sey, “Na mi win all dis nashons by mysef. I strong well-well, wise and get sense. I skata nashons boundary kon karry all dia propaty. Na with my strong hand and pawa I take distroy strong rulers and kings.
Yu trust yor wikedness kon sey, ‘Nobody dey si mi.’ Yor wisdom and di sense wey yu get dey deceive yu wen yu sey, ‘I dey special and nobody bi like mi.’
Naw, make yu listin, yu wey dey enjoy yorsef kon tink sey yu dey save and sikure. Yu tell yorsef sey, ‘I too mush and nobody bi like mi. My husband or shidren nor go ever die.’
Pesin wey nor dey play pipol wayo or tif from pipol. Anytin wey pesin gi-am, so dat e go borrow di pesin money, e dey riton am give di pesin; e dey give food to pipol wey dey hongry and doz wey dey naked, e dey give dem klot wear.
Dis na di find town wey dem guide well-well before. Di town bin dey boast sey, “Na mi great pass! E nor get any town wey bi like mi!” But naw, si as e don turn where dem dey trowey dirty put and na wild animals dey stay der naw. Evribody wey dey pass der, dey laf and shake dia head bikos of am.
Fear katch Felix, as Paul dey tok about di Good News, sef kontrol and how God judgement go take kom, so e kon tell Paul, “Make yu go first, wen I get time, I go sey make dem bring yu kom again.”
but I first go Damaskus, go tell di pipol wey dey der and den, I kon go meet di pipol wey dey for Jerusalem and Judea. Afta, I go meet Gentile pipol sey, make dem turn from sin kom meet God and make dem do tins wey go show sey, dem don really turn from sin kom meet God.
So, bikos wi know wetin e mean to fear God, naim make us dey prish and beg pipol. But God know us well-well and I hope sey una know us well-well for una mind too.
Make una take di klot go give who get am wen evening rish, so dat en body go dey warm for nite and e go bless una, den di Oga una God go si una as pipol wey dey do good.