21 Tree wey get fine leaf and fruit wey go beleful evribody wey dey di world and where wild animals and birds dey stay,
Di birds dey make dia house for der and di stork bird dey stay for di trees wey always dey green.
and na on-top di mountin wey high pass for Israel. E go grow kon get branches; bear seed and e go bi very fine cedar. Difren birds go stay der kon build house put for di cedar tree.
Difren birds dey build dia house for der and wild animals dey born for under di tree. All di kountries for di world dey rest under en shadow.
E don make yu ruler ova human being, animals and birds for dis eart. Na yu bi di head among all gold.
“E tall rish di sky and yu go si am for anywhere wey yu dey for dis world.
Di tree wey yu si, wey grow big and strong rish heaven, wey dem fit si from any part for di world.
na yu, my king! Yu don dey big and strong; yu don big sotey yu dey rish di heaven and yor pawa rish di end for di world.
E bi like mustard seed wey pesin plant for en farm. Di seed grow kon turn to big tree and birds build dia house for di tree.”