Sojas from one wiked kountry go kut am down kon leave am der make e die. En branches wey don break go fall on-top all di mountins and valley for di kountry. All di kountries wey bin dey stay under am, go run leave am.
Una wey bi Kapanaum pipol, una feel sey una fit karry unasef go heaven? No! God go trow una for hell-fire, bikos if to sey dem do di mirakles wey dem do for una, for inside Sodom, di town for still dey till today.
Israel pipol, make una listin! Today una won cross Jordan River kon go take doz strong pipol wey get pawa pass una, land. Dem dey stay for towns wey di wall rish di sky!