25 Di king kon tell dem, “But I dey si anoda pesin for der, dem nor tie am and e just dey waka round di fire! Nor-tin don happen to dem! And di nomba four pesin bi like angel!”
Who don go heaven kom back? Who don ever katch breeze for en hand or wrap wota for klot? Who kreate di whole world? Na who e bi and na wetin bi en pikin name? Make yu tell mi, if yu know!
Wen una dey pass thru deep wota, I go dey with una. Una go fit handle any wahala wey kom una way. Wen una pass thru fire, e nor go burn una. Di temptashon wey go kom, nor go too hard for una.
Nebukadnezzar kon sey, “I praiz Shadrak, Meshak and Abednego God, bikos na-im send en angel kom diliver en savants wey trust am. Dem nor gri obey di king kommand! Instead make dem bow woship my god, dem risk dia life kon sey, ‘Na only awa God wi go woship.’
Di king kon dey happy, so e orda make dem bring Daniel kom out from di pit. Dem bring Daniel out from di pit and e nor get sore for body or any mark, bikos e bilive di God wey e dey serve.