22 Bikos di king kommand too dey kwik and di fire dey hot pass normal, di men wey go trow dem for inside di fire die too, bikos of di way di fire dey hot.
But di pesin wey bi guide di kourt kom shange dia names. E give Daniel, Belteshazzar; Hananaya kon bi Shadrak; Mishael kon bi Meshak and Azaraya kon bi Abednego.
Di king kon orda sey, “All di pipol wey lie for Daniel head, make dem katch dem, dia wifes and shidren kon trow dem for di lion pit.” Dem nor even rish groun before di lion dem bigin chop dem with dia bones.
Wen Herod send pipol go find am and dem nor si am, e kweshon di sojas wey dey guide Pita kon kommand sey make dem kill all of dem. Den Herod komot from Judea go Caesaria go stay.