Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Daniel 3:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Yu orda sey, wons wi hear di music dey play, evribody must bow kon woship di gold image

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Daniel 3:10
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

David still kommand Levi leaders sey, “Make Levi pipol use harp and cymbals take play music.”


So evribody for Israel follow di Kovenant Box go rish Jerusalem dey happy, dey play trumpets, horns and cymbals kon dey sing and dance.


Di king follow di advise wey God give King David thru Profet Gad and Profet Natan. E put Levi pipol for di temple with harp and cymbals.


Wiked leaders go fit sey God dey dia side? Leaders wey dey use di laws take opress pipol!


“Anytime wen una dey help di Hibru wimen wey won born, if una si sey di pikin na boy, make una kill-am, but if na girl, make una nor kill-am.”


So Fero kommand en pipol, “Make una go kill any boy wey dem just born kon trow dem inside River Nile, but make una leave all di girls.”


I still si sey, for dis world, yu go si wikedness for where good judgement and rite pipol suppose dey.


Una own don finish! Una wey dey make wiked laws and dey opress my pipol.


and anybody wey nor gri bow woship di image, dem go trow am inside fire.


So naw, if una don ready, wons una hear di trumpet, di horn, lyre, jita, harp and all di oda instrument sound, make una bow woship di image. If una nor gri, na wons I go trow una enter di fire. Abi una tink sey any god dey wey go save una?”


all of dem gada go meet di king kon tell am, “Awa king! Shebi yu sign orda sey for thirty days make anybody nor pray give human being or gods escept yu and yu sey who pray give any oda god, make dem trow am for lion pit?” Di king ansa, “Una dey korrect! E dey for Mede and Persia Law and dem nor go fit shange am.”


Una dey sing difren songs and dey play harp, just as David bin dey do.


(By dis time, di priest oga dem and di Farisee pipol don give orda sey, anybody wey know where Jesus dey, make e kon tok, so dat dem go-go katch am).


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ