But afta yu, anoda kingdom go kom, dem nor go get pawa rish yor own and afta dat one, di third kingdom wey bi bronze, wey go rule di whole eart, go kom.
Yorsef si di leg and di toe wey dem make with iron and san-san. Dis one mean kingdom wey divide into two. Some of en pawa go bi like iron, aldo dem mix di iron with san.
“As I still dey look for di vishon, di nomba four beast kom out: E get pawa, e wall-wall and pipol dey fear am well-well. En tit dem na iron. E dey distroy and skata anytin kon use en leg take skata wetin remain. E dey difren from all di beast wey first kom and e get ten horn.
E go dey strong, but nor bi by en own pawa. E go kause strong wahala kon prosper for evritin wey e dey do. E go distroy doz wey get pawa and pipol wey dey serve God.
“ ‘Afta di sixty-two weeks, di Pesin wey God choose, go die and nor-tin go remain. Di ruler wey get pawa pass, go bring sojas kom distroy di town and di temple. Di end go rush kom like wota; e go bring war and distroshon, just as God plan am.