Fero kon tell Josef, “I dream one kind dream and e nor get anybody wey fit tell mi wetin di dream mean. But I don hear about yu sey yu dey fit tell pipol wetin dia dream mean.”
But di pesin wey bi guide di kourt kom shange dia names. E give Daniel, Belteshazzar; Hananaya kon bi Shadrak; Mishael kon bi Meshak and Azaraya kon bi Abednego.
E get one kind pawa with knowledge and wisdom. E dey solve problem wey pesin nor know. E go tell yu wetin dream or vishon mean; so make yu send for dis man, dem dey koll am Daniel wey di king shange en name to Belteshazzar and e go tell yu wetin di writing mean.”
Naw, I don hear sey yu dey fit tok meaning and esplain wetin pesin nor undastand. If yu fit read dis writing kon tell mi wetin e mean, yu go wear royal purpol; dem go put gold shain for yor neck and na yu go bi nomba three man for dis kingdom.”