Den I hear di man wey wear linen wey dey on-top di river as e raiz en two hand face sky kon swear with God name sey: “Na only three and half years remain; by di time wen God don save en holy pipol from who dey sofa dem, all dis tins go don happen.”
Den I hear one angel dey ask anoda one sey, “How long dis tin wey dey happen for dis vishon go kontinue? Dis wiked tin wey dem dey do go replace di sakrifice wey dem dey do evriday? How long di sojas wey dey heaven and di temple go dey under en leg?”