“Wen yu don komplete dis days, yu go sleep again, but dis time, yu go sleep with di rite and Judah sins go dey yor head. I don sey dis one go bi forty days. One day go ripresent one year.
E go tok against God kon opress anybody wey dey serve God. E go try to shange laws, festivals and di pipol wey dey serve God, go dey under am for three and half years.
“ ‘Dat ruler go enter agriment with many pipol for one week, den for di middle of dat week, e go stop all di sakrifice and ofrin. Den e go start one bad tin wey go kause wahala and tins go bi like dat, until di time wey God sey E won distroy di wayo pesin wey kause di wahala.’ ”
Dis tin show sey na so too Israel pipol go dey: dem nor go get king or leader; dem nor go do sakrifice or serve stone again and dem nor go get juju or image wey dem go use take konsult dia gods.
“Wen una si wetin nor suppose happen dey happen for di Holy Place (make di pesin wey dey read, know wetin dis word mean), den doz wey dey Judea, must run go mountin.