Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Daniel 11:37 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

37 Di king nor go respet en papa gods, tok-less of di god wey wimen love. E nor go respet any god, but e go dey karry ensef up.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Daniel 11:37
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God kon tell di woman, “Wen yu dey labor, I go make am pain yu well-well. Na inside pain yu go take born shidren. Yu go won kontrol yor husband, but na-im go bi yor head.”


bikos God know sey wen una chop from di tree, una eyes go open and una go bi like God ensef, wey know wetin dey good or bad.”


I bilong to my love and e don take mi as en own.


Yu bin tell yorsef sey, “I go klimb go heaven go put my throne on-top di highest stars. I go sidan and rule like king for di highest mountin.


I go klimb go di place wey high pass for di kloud. I go bi like di Most High God!”


“Man pikin, na one blow I go take kill di pesin wey yu love pass. Make yu nor tok or kry.


“Man pikin, go tell Tyre king wetin mi God wey get pawa dey tell am: “Yu dey proud and yu dey sey yu bi god wey sidan for throne and sea dey round yu. Yu fit pritend sey yu bi god, but make yu know sey na human being yu bi and nor bi wetin yu tink.


“Den di king go do wetin e like. E go dey make mout and karry body up sey, ‘I get pawa pass any oda god. I even high pass God wey dey heaven.’ E go dey susid until di time wey God won ponish am, don rish. God go do wetin E don plan.


Na only di gods wey get pawa well-well, e go dey respet. Gods wey en papa nor know, na-im e go honor with gold, silva, fine stones and propaty.


E still dey praiz ensef pass di sojas for heaven. E stop di sakrifice wey dem dey offa give God evriday kon skata where dem for dey woship God.


and among di pipol wey una take so, una si fine woman for inside wey una like marry,


Make una nor dey like anoda pesin wife or husband, or sey yu like to take pesin house, land, savants, animal or any oda tin.”


E go oppoz and karry ensef pass God and oda tins wey pipol dey woship. E go even sidan for God Temple dey tok sey e bi God.


Dem dey tish sey, e nor good to marry or chop some kind food. But na God kreate dis food and E sey pipol wey bilive di trut fit chop am afta dem don tank am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ