Na silva and gold from Spain and Ufaz dem take kover di juju. Na doz wey sabi karve make am with dia hand kon dress am with violet and purpol klot wey dem weave.
At wons, six men just kom out from di nort gate for di temple, each of dem karry swod. E get one man among dem wey wear linen and e whole sometin for hand wey e won take rite. All of dem kon stand near di bronze altar.
For inside vishon dat nite, I si one man dey ride one red horse, den e stop for one valley wey trees full and I kon si anoda red, brown and white horse wey get black spot for body, dey follow am for back.
Wen Joshua don near Jeriko, e look up kon si one man stand for en front and di man hold swod for hand. Joshua waka go meet am kon ask, “Yu dey with us, abi yu dey against us?”