16 Den di angel wey bi like human being, appear kon tosh my lip. I open my mout kon start to tok. I tell am, “Oga God! Dis vishon don make mi weak and na-im make mi dey shake anyhow.
bikos di more I dey find out, di more e dey worry mi well-well, bikos plenty wisdom dey bring plenty wahala too. So di more yu know, di more yu dey kause wahala for yorsef.
On-top di flat crystal wey dey dia head, e get one tin wey bi like throne wey dem make with safaya. On-top di throne, wetin dey der, bi like human being.
Den wen I tok to yu again kon give yu di pawa to tok, yu go tell dem wetin mi wey bi God tok. Some of dem go listin, but some nor go listin to wetin yu dey tok, bikos na bad pipol full der.”
Den Daniel (wey en name na Belteshazzar) kon dey worry sotey e nor fit tok anytin. Di king kon tell am, “Belteshazzar, make yu nor let dis dream and en meaning worry yor mind.” Daniel ansa, “My king, e for betta sey dis dream na for yor enemy and wetin e mean, na for di pipol wey dey trobol yu!
“Na like dis di matter take end. But for mi, Daniel, my mind kon dey disturb mi well-well and I kon kover my face bikos I dey fear. But I still keep evritin to mysef.”
Gabriel stand near mi, so bikos I dey fear, I kon fall face groun. Naim e sey, “Man pikin, make yu undastand wetin e mean. Di vishon dey show yu how di world go take end.”
So I faint and I kon dey sick for some days. Den afta, I get up kon go do di work wey di king sey make I do. But di vishon still dey sopraiz mi, bikos I nor fit undastand wetin e mean.
Gideon ansa, “My Oga! If God really dey with us, wetin make all dis tins dey happen to us? And where all di mirakle wey awa grand-grand papa dem tell us? Bikos dem sey, ‘Na God take us komot from Egypt!’ But naw, God don forget us kon allow Midian pipol dey rule us.”