13 Di prince for Persia kingdom oppoz mi for twenty-one days. But Mikael, one strong angel for heaven kom help mi, bikos na only mi dey Persia.
So dem stop to build di temple until di sekond year wen King Darius dey rule for Persia.
“Den Mikael; di great prince wey dey guide yor pipol, go appear. Dat na wahala time and dis kind wahala neva happen for anywhere kom rish naw. But yor own pipol wey dia name dey di book wey get life, go eskape.
Bikos, wi nor dey fight against human being, but na against di wiked rulers wey dey for dis world, against evil spirits and pawas wey dey di heavens.
And una dey komplete inside am; bikos na-im bi di head for all di pawas wey dey for heaven and eart.
Wi bin won kom si una (mi wey bi Paul don try to kom many times), but Satan spoil awa plan.
go heaven kon go sidan for God rite hand, where e dey rule di angels and doz wey get pawa.
But wen Mikael, di big angel dey kworel with devil bikos of Moses body, e nor curse am, but instead, e sey, “Na God go judge yu!”
Den big fight kon happen for heaven. Mikael and en angels kon fight against di dragon and en angels.