Wen Israel pipol hear how Solomon take judge di kase, all of dem kon dey respet am, bikos dem know sey na God gi-am di wisdom wey e take dey judge well.
My Oga God! Make Yu give mi wisdom and undastandin, so dat I go fit lead yor pipol well. Bikos without wisdom, nobody go fit rule dis yor great nashon well.”
naw, wisdom and undastandin, na yor own. I go still give yu money, propaty and di kind honor wey pass evry oda king wey dey before and wey go dey afta yu.”
God dey give wisdom, knowledge and joy to pipol wey dey do wetin E wont. But if pesin wey dey sin get money and propaty well-well, God go take dem from am kon gi-am to pesin wey dey do wetin E wont. All dis tins dey yuzles too and dem bi like wen pesin dey porshu breeze.
Any matter wey koncern wisdom and knowledge wey di king ask dem, e dey si sey dia ansa betta well-well pass di ansa wey all di wise men, majik pipol and di pipol wey dey tok wetin go happen for future, dey give.
yong men wey nor get any diziz for body; wey fine; wey dem don train and wey go fit learn kwik-kwik, so dat dem go dey serve and work for di king palis. E still sey make Ashpenaz tish dem di language and evritin for Babilon.
For di third year wen King Cyrus for Persia dey rule, God kon give Daniel (wey dem dey koll Belteshazzar) one message. Dis message na true, but e hard to undastand. Daniel undastand di message thru di vishon wey e si.
kon save am from all en wahala and from Fero wey bi Egypt king, E gi-am favor with wisdom and Fero kon make am oga for di whole Egypt and ova evritin wey e get.
Bikos of dis, wi too, since wi hear about una, wi neva stop to dey pray for una. Wi dey tell God make E show una wetin E wont, so dat una go dey wise and undastand God Spirit,