Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Daniel 1:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Wen ten days don finish, dia body betta and dem get flesh pass di yong men wey dey chop and drink di royal food and wine.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Daniel 1:15
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So e dey good to fear God with di small money wey pesin get, dan to do evil kon get money well-well.


“If una serve di Oga una God, E go bless una bread and wota kon remove all una sickness.


Wen God bless pesin, e dey get enough and nor-tin go make am regret.


Di pesin wey dey guide dem so kon gri with wetin e tok and e test dem for ten days.


Una plant many korn, but wetin una harvest, small. Una get food to chop, but e nor dey beleful una. Una get wine to drink, but e nor dey rish una! Even wen una wear many klot, e nor dey make una warm and pipol wey dey work, dia salari nor dey rish dem spend.


“Una dey put mind sey una harvest go plenty, but na small una dey get. Even wen una karry di small food wey una harvest rish house, I go blow dem trowey. Na wetin make mi do like dat? Na bikos my temple skata and all of una dey build fine-fine house for unasef.


Una must honor mi with wetin una dey do, but if una nor gri listin to wetin I dey tok, I go curse una. I go bikos of wetin una do, curse evritin wey una get. True-true, I don already curse una, bikos una nor gri honor mi.


Jesus ansa, “God word sey, ‘Nor bi only food man go take survive, but na with evry word wey God tok.’ ”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ