Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Amos 9:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 God sey, “Israel pipol, una dey important to mi pass Ethiopia pipol? Just as I bring Filistia pipol kom out from Krete and Siria pipol kom from Kir, na so too, I bring una kom out from Egypt.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Amos 9:7
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Assyria king ansa King Ahaz well; e attack and konker Damaskus. E karry di pipol go Kir kon kill King Rezin.


God kon help Asa and Judah pipol and dem kill Kush sojas, while di remainin ones kon run.


Zera wey kom from Kush attack dem with 1,000,000 sojas and 300 shariot. E go Maresha,


For dat day, Oga God take Israel pipol komot from Egypt akordin to der tribe.


Assyria king go karry Egypt and Ethiopia pipol go as prisonas. Weda dem yong or old, dem go waka naked with ordinary leg and dia yansh go dey open and e go bi shame for Egypt pipol.


Sojas ride horse from Elam land kom and dem karry bows and arrows. Sojas from Kir don dey ready to fight too.


Bikos na Mi bi di Oga wey bi una God. Israel pipol God wey dey holy, wey save una. I go sell Egypt, Sudan and Seba pipol, so dat una go dey free.


Black man fit shange en skin kolour, abi leopard fit komot di mark wey dey en body? If dem nor fit, den e go hard for wiked pesin to do good, bikos na only to do bad tins, e sabi.


Di time don rish wen dem go distroy Filistia pipol kon stop doz wey dey help Tyre and Sidon. Mi wey bi God go distroy Filistia pipol and all di pipol wey kom from Krete wotaside.


Na profet God take save Israel pipol from Egypt where dem bi slave and na profet e take guide dem.


I go skata Damaskus town gate; I go remove di ruler from Aven Valley kon kill di pesin wey whole di royal rod for Bet-Eden. Dem go katch Aram pipol kon karry dem go Kir land as prisona.” Dis na wetin God tok.


Na mi still bring una kom out from Egypt; lead una pass desert for forty years, den give una Amor pipol land.


But for Avvim pipol wey kom form Krete and dey stay di west side for Gaza and Kaftor pipol aria, make una distroy and take dia land.)


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ